UNIZIK Student Expelled After Confronting Lecturer in Viral Video Scandal
Authorities of di Nnamdi Azikiwe University don expel one student, Goddy-Mbakwe Chimamaka Precious, after dem say she assault one lecturer for di school.
Did you know? You can comment on this post! Just scroll down
Di lecturer na Dr Chukwudi Michael-Okoye of di Department of Theatre and Film Studies, while di student bin dey 300 level for di Department of History and International Studies.
Inside statement, di school say after dem set up a disciplinary committee wia both both parties bin get fair hearing, dem find say di student commit gross misconduct wey be violation of di university students disciplinary regulations, particularly Regulatio 4 (SDR).
"Based on di committee findings and recommendations, di Acting Vice-Chancellor, Prof. Joseph I. Ikechebelu, on behalf of di university senate, do approve di immediate expulsion of Goddy-Mbakwe Chimamaka from Nnamdi Azikiwe University, Awka." Di statement add.
Di video wey go viral, show as Dr Okoye wey be di lecturer bin tap Precious and tell her "excuse me" as im waka pass wia she stand dey video herself for hallway inside di school.
Precious come pause, make face wan kain as e be like she dey tell pesin wey stand for her front say "imagine, e just hit me".
Di video come show wia fight don burst and dem bin dey hold Precious back from confronting di lecturer.
Dis incident happun on Tuesday 11 February for south east part of Nigeria.
Video show di student as sem dey hold her back, di lecturer brown native clothes don tear for side.
She also been dey hold di lecturer, wey bin look calm throughout di incident.
UNIZIK bin say dem go take appropriate actions and sanctions go dey based on di outcome of di investigation.
"In line wit our core values of discipline, self-reliance, and excellence, and in adherence to di principles of fair hearing, equity, and justice, di Acting Vice-Chancellor, Joseph I. Ikechebelu, don order a full-scale, transparent, and unbiased investigation into di matter," na wetin di statement bin read .
"Nnamdi Azikiwe University still remain institution of learning wey dey uphold high moral and ethical standards. We no get place for indiscipline, misconduct, or any form of unacceptable behaviour within our community," di statement bin add.
Fotos online bin also reveal deep bite marks for di lecturer hand.
Video Posted 5 Days ago. You can post your own videos and it will be published for free.
No Registration is required! But we review before publishing! Click here to get started




One Favour Please! Subscribe To Our YouTube Channel!
468k
Cook Amazing Nigerian Dishes, Follow Adorable Kitchen YouTube Channel!
1.1m
Like us on Facebook, Follow on Twitter
React and Comment
Click Here To Hide More Posts Like This
Watch and Download Free Mobile Movies, Read entertainment news and reports, Download music and Upload your own For FREE.
Submit Your Content to be published for you FREE! We thrive on user-submitted content!
But we moderate!